bbc.com

Anglophone crisis: Cameroon separatists 'bomb' military moto for Kembong - BBC News Pidgin

  • ️https://www.facebook.com/bbcnews
  • ️Fri Nov 30 2018

Di moto wey dem bomb

Wia dis foto come from, Cameroon Army

Wetin we call dis foto, Di moto wey dem bomb

30 November 2018

Cameroon army don release pishures of attack against one military convoy wey happun for Kembong villiage on Thursday for di South-West region.

No soldier die for di attack and e no clear if anyone wound.

Although army never tok how e happun, Cameroon separatists wey dey fight for di independence of pipo for di English speaking parts of di kontri don claim responsibility for di attack, dem say dem plant di bomb for road to stop di army from entering di area.

Di moto wey dem bomb

Wia dis foto come from, Cameroon Army

Kembong na one of di places wey di fight-fight between Cameroon army and anglophone fighters wey wan Ambazonia don affect pass, BBC tori pesin, Peter Tah tok say dis bomb mata fit make mata worse.

E don pass one year wey palava don dey inside di English speaking regions and plenti pipo don die ontop while some don run go neighbouring kontris as refugees.

Anglophone Cameroon pipo dem say di francophone pipo dey discriminate against dem inside court and schools.

  • Di front of di Catholic church where dem kill di priest.

  • Cameroon soldiers for dey stand for dia station dey watch

  • Government don try to stop di protests

  • Delphine Kinyuy Dzelafen

Top Tori

Informate me

  • Business Mogul Aisha Achimugu

  • Remi Tinubu

  • King Charles III smiles for di crowd during a visit to Banbridge Old Town Hall on day three of di royal visit to Northern Ireland - e get a slight smile, and wearing a gray suit, wit a pinkish shirt and tie

  • Abisola Kola-Daisi

  • Dr Sophie Chandauka and Prince Harry  togeda for one Sentebale event for 2024

  • A collage photo of Oby Ezekwesili, Onyekachi Nwebonyi, Natasha Akpoti Uduaghan, Abdul Ningi and Ali Ndume

  • US President Donald Trump (CR) and NATO Secretary General Mark Rutte (CL) wit US Vice President JD Vance (3R) and US Secretary of Defense Pete Hegseth (2R) during dia meeting for di Oval Office of di White House for Washington, DC, USA, 13 March 2025.

  • Vice Admiral Ibok-Ete Ibas and Professor Ibiba Lucky Worika

Di one wey oda users dey read well well